Rules wey dey guide Paxful Stablecoin

E go start: March 4,2021

ABEG READ DIS AGREEMENT CAREFULLY. Say you dey use Paxful Stablecoin service. you gree to dey bound by dese supplemental "Rules wey dey guide Paxful Stablecoin" and you acknowledge and gree say don read am carefully and thoroughly, undastand and accept all di rules and conditions wey dey inside am, wey add join di rules wey dey guide( di "Agreement'). Any term wey capitalize wey dem use but no define for down get wetin im mean for inside di Agreement. If any conflict come between di Agreement and di Paxful StablecoinRules wey dey guide wen you dey use or dey relate wit your use of di Paxful stablecoin service, den na Paxful Stablecoin go get control.

About Paxful Stablecoin

Di Paxful Stablecoin service na referral mechanism wey dey allow you, paxful pesin wey qualify, to enta into padi-to-padi buy abi sell with anoda pesin compani wey dem don select before (di "Stablecoin Counterparty"), by paxful, for di rate wey you go take change Bitcoin for USD-wey be equal amount of Stablecoins, wey be say na Stablecoin Counterparty go hold am for your own gud. Na from dis model, Paxful Stablecoin dey allow you to comot from your Bitcoin position into di Stablecoin wey dem choose.

Referral Mechanism

Di Paxful Stablecoin service na limited referral mechanism wey dey available ontop di paxful platform. As you talk say you get interest to perform for di buying abi selling of Paxful Stablecoin, Paxful go refer you to di Stablecoin Counterparty for di buying and selling to happen. You must dey follow di prompts wey dem give in oda to submit your offer rules to di Stablecoin Counterparty. If di Stablecoin Counterparty accept your offer rules, di buy and sell go happun between you and di Stablecoin Counterparty. As dis na di standard way wey dem take dey buy abi sell for dia platform, Paxful no go get involvement, control, power, discretion, abi authority for di buy abi sell of Paxful Stablecoin wey you enta abi wey dey between you and di stablecoin Counterparty. Paxful no go hold any stablecoins abi advise abi tell any paxful pesin to buy di stablecoins.

Di Stablecoin Counterparty fit get dia own rules and conditions for di buy abi sell for paxful stablecoin service, and di Paxful Stablecoin Service fit dey vary di rate wey you go use change, speed to take change, and oda rules and conditions wey di Stablecoin Counterparty(di "Stablecoin counterparty Rules") put. Say you enta buy abi sell with di Stablecoin Counterparty you don gree to dey bound by di Stablecoin Counterparty Rules. Di Stablecoin Counterpary rules dey valid for all cases apart From wen dey contradict abi violate di Agreement, dese paxful stablecoin rules wey dey guide, dey ilegal, dey unreasonable abi odawise hard to follow( as na paxful get di sole and absolute discretion), abi if you and di stablecoin counterparty gree to change di Stablecoin counterparty rules. NA YOUR RESPONSIBILITY TO DEY CAREFUL AS YOU DEY READ DI STABLECOIN COUNTERPARTY RULES MAKE YOU FOLLOW DEM EXACTLY. IF YOU NO FOLLOW DI STABLECOIN COUNTERPARTY RULES, YOUR BUY ABI SELL FIT DON DENY. NEVA ENTA INTO PAXFUL STABLECOIN SERVICE BUYING ABI SELLING UNLESS YOU DON FOLLOW ALL DI RULES AND CONDITIONS WEY DEY LIST. IF YOU FAIL TO FOLLOW DI RULES AND CONDITIONS, PAXFUL FIT NOT DEY ABLE TO HELEP YOU FOR FIGHT PROCESS TO TAKE COLLECT YOUR MONI.

Moni

Paxful go always dey transparent about our moni. Any moni go apply to your use of paxful service. For more info and updates on how to change moni, abeg go our Helep center.

Accounts wey don qualify and Jurisdictions wey don restrict

Di paxful Stablecoin service don dey available for only pipo wey qualify for di service. In oda to qualify to use di paxful stablecoin service, you must confam your account and get at least USD $1.00 worth of Bitcoin wey dey your paxful online purse, plus any bitcoin amount wey add join to nid to cover any moni wey associate am. paxful get di right to prohibit abi modify di paxful selection service for any paxful pesin, and di Stablecoin Counterparty fit reject any buy abi sell with any paxful pesin. E add join to di jurisdiction wey dey restricted as forth for section 2.7 of our Rules wey dey guide, di paxful service no dey available for pipo wey dey stay State of texas.

WARRANTY NO DEY, LIMITATION OF LIABILITY & ASSUMPTION OF RISK

DI PAXFUL STABLECOIN SERVICES DEY GIVE FOR "AS IS" AND "AS AVAILABLE" BASIS WITHOUT ANY GUARANTEES, REPRESENTATIONS ABI WARRANTIES. WHETHER EXPRESS, IMLIED OR STATUTORY. TO DI BIGEST EXTENT WEY DEY ALLOWED BY DI APPLICABLE LAW, PAXFUL SPECIFICALLY DISCLAIM ANY IMPLIED WARRANTIES OF TITTLE, MERCHANTABILITY, FITNESS FOR ONE PARTICULAR PURPOSE AND/ ABI NON -INFRINGEMENT. PAXFUL NO DEY MAKE ANI REPRESENTATION OR WARRANTIES WEY ACCESS TO DI WEBSITE, ANY PART OF DI SERVICES, ABI ANY OF DI MATERIALS WEY CONTAIN INSIDE, GO DEY CONTINOUS, UNINTERRUPTED, TIMELY ABI ERROR-FREE. PAXFUL NO DEY LIABLE FOR ANY LOSS IM PESIN FIT SUFFER. YOU GO ACKNOWLEDGE AND GREE SAY YOU NEVA RELIED UPON ANY ODA STATEMENT ABI UNDERSTANDING, BY MOUTH ABI DEM WRITE AM, WITH RESPECT TO YOUR USE AND ACCESS OF DI SERVICES AND WEBSITE. WEY BE SAY YOU NO LIMIT DI FOREGOING, YOU GO COME ACKNOWLEDGE AND ACCEPT DI VARIOUS RISKS WEY DEY INSIDE USING DIGITAL KAIN MONI WEY BE BUT NO BE ONLY REGULATORY RISK, HARDWARE FAILURE, SOFTWARE ISSUES, INTANET CONNECTION FAILURE, MALICIOUS SOFTWARE, ANODA PESIN INTERFERENCE WEY GO LEAD TO LOSS ABI LACK OF ACCESS TO YOUR ACCOUNT ABI ONLINE PURSE AND ODA PESIN INFO. SERVER FAILURE ABI INFO LOSS. YOU GO ACCEPT AND ACKNOWLEDGE SAY PAXUL NO GO DEY RESPONSIBLE FOR ANY COMMUNICATION FAILURES, DISRUPTION, MISTAKES, DISTORTIONS ABI DELAY WEY YOU FIT EXPEREIENCE WEN YOU DEY USE DI SERVICES.

IN NO EVENT NA IM PAXFUL, IM AFFILATES AND SERVICE GIVERS, ABI ANY OF DIA RESPECTIVE OFFICERS, DIRECTORS, AGENTS, EMPLOYESS, ADVISORS, CONSULTANTS ABI REPRESENTATIVES GO DEY LIABLE (A) FOR ANY AMOUNT WEY BIG PASS DI VALUE OF DI TOTAL MONI WEY YOU PAY FOR DI SERVICE WEY DEY SUBJECT TO DI CAUSE OF ACTION FOR DI TWELVE(12) MONTHS BEFORE DI LOSS ARISE ABI (B) FOR ANY PROFIT WEY LOST, DIMINUTION FOR VALUE ABI BUSINESS OPPORTUNITY, ANY LOSS, DAMAGE, CORRUPTION ABI BREACH OF INFO ANY ODA INTANGIBLE, ABI CONSEQUENTIAL DAMAGES, WETHER BASED IN CONTRACT, TORT NEGLIGENCE, STRIVT LIABILITY, ABI ODAWISE, WEY COME OUT OF ABI IN CONNECTION WITH AUTHORIZED REPRESENTATIVE OF PAXFUL DON DEY ADVISED OF ABI SABI ABI SUPPOSE SABI DI KAIN DAMAGES, AND NOT WITHSTANDING DI FAILURE OF ANY AGREED OR ODA REMEDY OF IM OWN PURPOSE WEY DEY ESSENTIAL, EXCEPT TO DI EXTENT OF A FINAL JUDICIAL DETERMINATION WEY SUCH DAMAGES NA RESULT OF PAXFUL'S GROSS NEGLIGENCE, FRAUD, WILLFUL MISCONDUCT OR INTANATIONAL VIOLATION OF LAW. SOME JURISDICTION NO DEY ALLOW DI EXCLUSION OR LIMITATION OF INCIDENTAL ABI CONSEQUENTIAL DAMAGES, SO DI ABOVE LIMITATION FIT NO APPLY TO YOU.