Paxful Inc. RULES WEY DEY GUIDE

DIS AGREEMENT CONTAIN INFO WEY DEY IMPORTANT WEY DEY REGARD YOUR RIGHT AND OBLIGATIONS, AS WELL AS CONDITIONS, LIMITATIONS AND EXCLUSIONS WEY FIT APPLY TO YOU, ABEG READ AM WELL WELL.

Dese rules wey dey guide and any ammendments and restatements hereof (di "Agreement") form legal agreement wey dey cover di provision of services from Paxful to you, wey include offering platform wey dey make sure say pipo wey wan buy and pipo wey dey sell "Digital Assets" (di name wey una go undastand go include digital kain moni like Bitcoin, Tether and odas wey Paxful online purse dey support) to engage for wetin una don follow each oda buy abi sell ( di'Platform<"), wey dey offer hosted digital online purse services, dey hold and dey release Digital Assets as wetin dem tok wen you buy di digital asset finish and oda services dem wey dem describe for dis agreement(togeda d"Services dem" and only pesin, "Service") wey Paxful,Inc dey bring. and all of im affiliates dem, wey include but no be only Paxful USA,Inc. (togeda,"Paxful" abi "we' abi"us" abi di "company") to you as pesin (still refer to as "pesin" abi "you"). Na Paxful get and dey use Paxful.com and di services wey e dey do. Dis agreement go govan di way you dey use di services, with our Privacy Policy, Cookie Policy, and E-Sign Consent.

DESE RULES NID DI USE OF ARBITRATION TO SETTLE FIGHTS RADA DAN JURY TRIALS ABI CLASS ACTIONS.

As you dey regista to use account thru paxful.com, abi any websites, APIs, abi mobile applications wey dey with am, wey include any URLs dem wey Paxful dey operate (togeda di "Paxful Website" abi di Website"0, you gree say you go read, undastand well well and accept all of di rules wey dey guide wey dey inside di Agreement wey include our privacy Policy, Cookie policy, and E-Sign Consent.

DI VALUE OF DIGITAL ASSETS FIT GO UP ABI DOWN AND E FIT BE SUBSTANTIAL RISK WEY YOU FIT LOSE MONI AS YOU DEY BUY, SELL, HOLD, ABI INVEST FOR DIGITAL ASSETS. MAKE YOU CHECK AM WELL WELL WHETHER NA TO DEY BUY ABI SELL ABI TO DEY HOLD DIGITAL ASSETS DEY OK FOR YOU EVEN FOR YOUR OWN FINANCIAL CONDITION.

About Paxful and im Services

Paxful na padi-to-padi platform wey dey lead, dey facilitate di buy and sell of Digital Assets with pipo wey dey sell wey dey accept di way to take pay wey plenti pass 300 to take change dia Digital asset. Fit price and change Ways to take pay for basis of padi-to-padi basis wey dey between di pipo wey dey buy for di Platform ("Pipo wey dey buy" and Pipo wey dey sell for di Platform ("Pipo wey dey sell<"). Our pipo gree for which way to take pay take finish wetin una dey buy abi sell and go dey responsible and liable say you use dat kain way to take pay for way wey dey lawful.

Paxful dey also give hosted digital wallet services via global digital asset wallet provider wey dey lead. Awa worldwide userbase fit post offers to eida buy abi sell Digital Assets for plenti way wey easy. Pesin wey mek di offer dey responsible to tok how dem want di buy abi sell wey dey happun, plus way pesin wey you go use pay wey pesin wey dey Sell. Once anoda Paxful user don chus offer, Pesin wey dey sell Digital Assets go dey locked as part of awa procedures for wetin you don buy (wey we call “Paxful Escrow”) until all conditions wey necessary to finish di buy abi sell don happun. Di sell go complete and Digital Assets go open and Pesin wey dey sell go send am go di Pesin wey wan buy once the Pesin wey wan buy don finish di rules wey dey guide di buy abi sell and don confam payment don correct and say Pesin wey dey sell don collect am. PAXFUL NO DEY ACT AS PAYMENT PROCESSOR. ALL LIABILITY WEY DEY TO SEND AND RECEIVE PAYMENT AND TO DEY CONFAM DI VALIDITY OF DI BUY ABI SELL DEY BETWEEN PESIN WEY DEY BUY AND PESIN WEY DEY SELL. We dey release di Digital Assets wey we lock back tgiv di Pesin wey dey sell if di Pesin wey dey Buy chus cancel di buy abi sell. Pesin wey dey sell fit no cancel di buy abi sell any time. Pesin wey wan sell onli fit chus to open di Digital Assets come release am for di Pesin wey wan buy. Dis na for security protection for Pesin wey dey buy. If Pesin wey wan sell wan cancel di buy abi sell sake of Pesin wey wan buy no follow rules wey dey guide di buy abi sell, dem must begin fight come giv reason for why dem do am as dem tok for Section 8 of dis Agreement. Buy abi sell for awa Website dey happun between di Pipo wey wan buy and Pipo wey dey sell. As e suppose be, Paxful no dey side any buy abi sell.

Di service wey Paxful dey bring to host digital kain moni online purse na safe way to kip, send and collect digital kain moni. Paxful no dey kip any Digital Asset. Na for im respective networks dem abi blockchain dem dey kip Digital Asset. All di buy abi sell dem of Digital kain moni dey happun for di network of di digital kain moni. Paxful get di right to say no to process any buy abi sell if di law nid am abi if we see say di buy abi sell dem no follow di rules wey dey guide for di Agreement. So you go accept and gree say you take full responsibility for all di tins wey fit happun unda your online purse and accept all risks of any access wey get authority abi no get authority to your online purse, to di maximum extent wey di law permit.

  1. GENERAL

    1. We get di right to amend, modify, change abi revise dis Agreement for any time, for our sole and absolute discretion and wey notice no go dey before. Dat kain change wey be for you to use di services go happun wen Paxful Website don post am and no be from date wey don pass. If you don supply us with email address, we fit still tell you thru email say dem don revise di Agreement. If you no gree to di rules of di Agreement wey dem don revise, di only way you fit do am na to quik quik end your use of di Service make you close your account.
    2. Na your responsibility to read di agreement well well and from time to time review dis agreement as dem dey post am for di Paxful Website. As you continue to dey use di service go show say you accept to dey bound by di agreement wey dey now.
    3. Failure abi delay by Paxful to dey enforce abi partially dey enforce any provision of di agreement no go mean say we wave away any of our rights abi remedies.
  2. ACCOUNT & REGISTRATION

    1. Mek you use di Services, you go nid register account via awa Website. Wen you dey regista am, we go ask you for som kain info, wey include but nobi only, your name, address and oda personal info to confam your identity. We fit, in awa sole and complete discretion, no gree to maintain an account for you. You now dey gree say you: (a) dey legal age for your respective jurisdiction to gree for dis Agreement; and (b) neva dem neva suspend abi comot you from dey use awa Services before.
    2. By to dey your account, you gree and represent say you go use awa Services for yourself and you no fit use your account to do middle man or broker for anyoda third party, pesin or entity. Unless Paxful gree you, dem dey gree mek you get onli one account and no dey gree mek you sell, borrow, share abi otherwise share your account abi any detail wey dey necessary to enta your account giv pipo abi entities wey nobi yourself. You dey solely responsible and liable to dey maintain correct security and control of any and all username, email address, passwords, two-factor authentication codes abi anyoda codes or credential wey you dey use enta di Services. Your account no go get lie lie info abi one wey go thief. Dem no dey gree mek you dey tok ie lie info for your account, to dey lie about your kontri wey from come abi to dey giv lie lie documents to take show who u be.
    3. Wen you dey regista your account, you gree to giv us di info we nid sake of to confam who u be and to dey check to dey hide moni, dey giv terrorist moni, thief, abi anyoda moni crime come gree mek we kip record of di kain info. You go nid finish some kain confamation procedures before dem gree you to use di Services, wey dem fit change di procedures sake of info wey dem collected about you for ongoing basis. Di info we dey nid fit be som kain personal info, plus, but nobi onli, your name, address, fone numba, e-mail address, date of birth, social security numba, taxpayer identification numba, and government identification. As you dey giv us dis abi anyoda info wey we fit nid, you dey confirm say all di information na true, correct and nobi lie. You gree to dey update us evritaim if any of di info wey you giv don change. YOU DEY AUTHORIZE MEK WE ASK QWESHON, WEDA NA DIRECT ABI VIA THIRD PARTIES, WEY WE DEY REASON SAY E DEY NECESSARY TO CONFAM WHO YOU BE ABI PROTECT YOU AND/OR US FOR THIEF OR ODA MONI CRIME, AND TO DO WETIN WE FEEL SAY DEY NECESSARY BASED ON DI RESULTS OF DI KAIN QWESHON. WEN WE DIS QWESHON, YOU GREE SAY WE FIT SHARE INFO WEY CONSAIGN YOU GIV CREDIT REFERENCE AND PIPO WEY DEY STOP THIEF ABI CRIME AND SAY DIS PIPO FIT ANSA AWA QWESHON COMPLETE.
    4. If you dey use di Services for any legal entity like corporate entity, you dey represent and dey warrant say: (i) di legal entity dey organized well and dey exist correct for jurisdiction laws of en organization; and (ii) you get complete authority from di kain legal entity to dey do tins on for dem. A corporate-verified account dey specific for dat legal entity and na onli pesin wey regista am fit use am. Dem no dey gree mek dem share corporate accounts with abi mek oda pipo abi entities dey use am. Corporate accounts wey dey verified fit do di kain following tins wey odas no fit:

      • Corporate account wey dey don approve fit get plenti active user accounts any time, as far as dem all don confam-company and na some major pipo wey dey work for di company dey work am wey dem don tok giv and don dey approved by Paxful for en sole and complete discretion;
      • Corporate accounts fit onli get one active offer for one particular buy abi sell wey don happun for any one time dem no dey gree mek dem plenty offers for dat kain particular buy abi sell wey don happun for dia oda corporate accounts.
    5. You dey solely responsible to mek strong password come maintain complete security and control of any and all IDs, passwords, hints, personal identification numba (PINs), API keys abi any oda codes wey you use dey enta awa Services. Any loss abi compromise for di info wey dey ground and/abi info wey consaign you fit cos mek third parties enta your account and any Digital Assets and/or moni wey dey your account go loss or dem go thief am, plus how you dey take pay wey join am. You dey solely responsible to kip your email address, telephone numba and oda contact details up to date for your account profile mek you fit get any notices abi alerts wey we fit send you. You no go gree remote access abi share your computer screen giv anoda pesin wen you dey logged in for your account. We no get responsibility for any loss wey you fit get sake of say you loss your account login info wey nobi Paxful fault and/or as you no fit follow or do somtin based on any notice abi alerts wey we fit don send giv you.
    6. To use awa Services you fid nid finish som kain legal tins for your kontri and/or state wey u dey live. By to dey gree these wetin dem wan for dis Agreement, you dey confam say you don check una local laws and regulations and say you sabi, and dey do, any and all dos kain tins. Sake of some legal or regulatory tins wey we no fit do, we no dey use awa Services for som kain law. By to dey gree wetin dem wan for dis Agreement, you dey confam say youno dey live abi dey follow di laws and regulations dos law.
    7. We fit no mek all di Services dey for evri markets and law and fit stop mek som law no dey use evri abi som part of di Services from (“Law wey dem Block”). For dis time, Law wey dem Block include dos one wey dey awa “List of Kontri dem Ban”, and di States of Washington and New York. Plus, di Services no dey for di digital moni, Tether (USDT), for users wey dey live for State of Texas. You no go try use awa Services if you dey for any of dat place wey get Law wey dem Block. You no go try corner any ban wey dem put via di Services, like to dey block your IP address or to dey submit any info wey no correct wey consaign wia you dey.
  3. JURISDICTION, ARBITRATION & SEVERABILITY

    1. Dis Agreement and how you dey use di Website and Services go dey under and go work one on one with State of Delaware, no go reason principles of conflict of laws.
    2. Arbitration. You and paxful go gree say any fight wey come from abi wey follow dis Agreement abi di Services, go settle for arbitration wey dey bind, for pesin basis, wey follow di American Arbitration Association of fights wey follow consumers ( fit check am for https://www.adr.org/rules). Subject to applicable jurisdictional requirements, consumer claimants ( pipo wey wetin dem don buy abi sell na for pesinal, family abi house use) fit choose to follow wetin dem tok say happun for dia local small court rada dan thru arbitration as long as dia mata remain for small claim court and follow only for one pesin (non-class abi non representative) basis.

      CLASS ACTION WAIVER: TO DI EXTENT WEY LAW PERMIT, ALL CLAIMS GO COME FOR ONLY PESIN BASIS, AND NO BE AS PLAINTIFF ABI CLASS MEMBER FOR ANY CLASS WEY BE LIKE SAY NA TRUE, COLLECTIVE ACTION, ABI REPRESENTATIVE WEY DEY PROCEED ("CLASS ACTION WAIVER"). DI ARBITRATOR FIT NO CONSOLIDATE PASS ONE PESIN CLAIM ABI ENGAGE FOR ANY CLASS ARBITRATION. YOU GREE SAY, AS YOU GREE FOR DIS RULES, YOU AND PAXFUL DON COMOT ANY RIGHT WEY UNA GET TO TRIAL BY JURY AND YOU DEY COMOT DI RIGHT TO FOLLOW FOR CLASS ACTION AGAINST PAXFUL.

      Di Federal Arbitration Act,9 U.S.C SS 1-16, dey apply fully to di arbitration. Na single,neutral arbitrator go conduct di arbitration and e go happun for di State of Delaware, abi anoda place wia dem two gree, for di English language. Di arbitrator fit award any relief wey court of competent jurisdiction fit award, wey include attorneys' moni wen di law authorize am, and di arbitral decision fit don enta as judgement and fit enforce am for any court of law. For your request, fit conduct hearings in pesin abi for fone and di arbitrator fit submit and sabi motions for briefs, wey no get oral hearings. Di party wey dey in action abi dey proceed to enforce dis Agreement go pay di costs and attorney moni.

      If di arbitrator(s) abi arbitration administrator go put filing moni abi oda administrative cost for you, we go give you back, upon request, to di extent dat kian cost abi moni go pass wetin you for pay if you bin wan go court. We go still pay moni add join abi cost if di rules of di arbitraton administrator ask say make we pay or if na so di law tok. Apart from dis one wey dey go so, each party go dey responsible for any oda moni abi costs, like attorney moni wey di party fit incur.

    3. If any arbitrator or court of United States tok say any part of dis Agreement no dey valid or dem no fit enforce am complete abi for part, the validity or enforceability of di oda sections of how we take dey operate no go fit dey affecte. Any headings wey dey dis Agreement na for informational purposes onli and nobi provisions for dis Agreement wey dem fit enforce.
  4. PRIVACY POLICY & SECURITI

    1. We dey try do evritin wey we fit to protect your personal info. But as e be, we no git guarantee di security of any data you dey show online. You gree di security risks wey dey to dey giv information and to dey buy abi sell online for Internet and no go hold us for any security issue unless na we cos am.
    2. Abeg luk awa official privacy statement: https://paxful.com/privacy.
  5. WARRANTY NO DEY, LIMITATION OF LIABILITY & ASSUMPTION OF RISK

    1. DI SERVICES DEY GIVE FOR "AS IS" AND "AS AVAILABLE" BASIS WITHOUT ANY GUARANTEES, REPRESENTATIONS ABI WARRANTIES. WHETHER EXPRESS, IMLIED OR STATUTORY. TO DI BIGEST EXTENT WEY DEY ALLOWED BY DI APPLICABLE LAW, PAXFUL SPECIFICALLY DISCLAIM ANY IMPLIED WARRANTIES OF TITTLE, MERCHANTABILITY, FITNESS FOR ONE PARTICULAR PURPOSE AND/ ABI NON -INFRINGEMENT. PAXFUL NO DEY MAKE ANI REPRESENTATION OR WARRANTIES WEY ACCESS TO DI WEBSITE, ANY PART OF DI SERVICES, ABI ANY OF DI MATERIALS WEY CONTAIN INSIDE, GO DEY CONTINOUS, UNINTERRUPTED, TIMELY ABI ERROR-FREE. PAXFUL NO DEY LIABLE FOR ANY LOSS IM PESIN FIT SUFFER. YOU GO ACKNOWLEDGE AND GREE SAY YOU NEVA RELIED UPON ANY ODA STATEMENT ABI UNDERSTANDING, BY MOUTH ABI DEM WRITE AM, WITH RESPECT TO YOUR USE AND ACCESS OF DI SERVICES AND WEBSITE. WEY BE SAY YOU NO LIMIT DI FOREGOING, YOU GO COME ACKNOWLEDGE AND ACCEPT DI VARIOUS RISKS WEY DEY INSIDE USING DIGITAL KAIN MONI WEY BE BUT NO BE ONLY HARDWARE FAILURE, SOFTWARE ISSUES, INTANET CONNECTION FAILURE, MALICIOUS SOFTWARE, ANODA PESIN INTERFERENCE WEY GO LEAD TO LOSS ABI LACK OF ACCESS TO YOUR ACCOUNT ABI ONLINE PURSE AND ODA PESIN INFO. SERVER FAILURE ABI INFO LOSS. YOU GO ACCEPT AND ACKNOWLEDGE SAY PAXUL NO GO DEY RESPONSIBLE FOR ANY COMMUNICATION FAILURES, DISRUPTION, MISTAKES, DISTORTIONS ABI DELAY WEY YOU FIT EXPEREIENCE WEN YOU DEY USE DI SERVICES.
    2. IN NO EVENT NA IM PAXFUL, IM AFFILATES AND SERVICE GIVERS, ABI ANY OF DIA RESPECTIVE OFFICERS, DIRECTORS, AGENTS, EMPLOYESS, ADVISORS, CONSULTANTS ABI REPRESENTATIVES GO DEY LIABLE (A) FOR ANY AMOUNT WEY BIG PASS DI VALUE OF DI TOTAL MONI WEY YOU PAY FOR DI SERVICE WEY DEY SUBJECT TO DI CAUSE OF ACTION FOR DI TWELVE(12) MONTHS BEFORE DI LOSS ARISE ABI (B) FOR ANY PROFIT WEY LOST, DIMINUTION FOR VALUE ABI BUSINESS OPPORTUNITY, ANY LOSS, DAMAGE, CORRUPTION ABI BREACH OF INFO ANY ODA INTANGIBLE, ABI CONSEQUENTIAL DAMAGES, WETHER BASED IN CONTRACT, TORT NEGLIGENCE, STRIVT LIABILITY, ABI ODAWISE, WEY COME OUT OF ABI IN CONNECTION WITH AUTHORIZED REPRESENTATIVE OF PAXFUL DON DEY ADVISED OF ABI SABI ABI SUPPOSE SABI DI KAIN DAMAGES, AND NOT WITHSTANDING DI FAILURE OF ANY AGREED OR ODA REMEDY OF IM OWN PURPOSE WEY DEY ESSENTIAL, EXCEPT TO DI EXTENT OF A FINAL JUDICIAL DETERMINATION WEY SUCH DAMAGES NA RESULT OF PAXFUL'S GROSS NEGLIGENCE, FRAUD, WILLFUL MISCONDUCT OR INTANATIONAL VIOLATION OF LAW. SOME JURISDICTION NO DEY ALLOW DI EXCLUSION OR LIMITATION OF INCIDENTAL ABI CONSEQUENTIAL DAMAGES, SO DI ABOVE LIMITATION FIT NO APPLY TO YOU.
    3. We no get abi dey control di software protocol wey dey govern di operation of Digital Asset. Generally, di protocol wey dey unda na open source and anyone fit use, copy, modify and distribute dem. We assume say responsibility for di operation of di protocols wey dey unda and we no go fit guarantee di function dem abi securiti of network operations. For particula, di protocols wey dey unda fit change di rules e take dey operate ( wey include "forks"). Any of dat kain material operating service fit materially affect if e dey available, di value, function and /abi di name of dat digital kain moni. Paxful no fit control di time and features of dese material change wey dey operate. Na your responsibility to make yoursef sabi di changes wey dey operate wey dey come and you go consider info wey dey available for public well well and info wey Paxful bring to sabi whether to continue to dey use di services. For di event of any such operational change, Paxful get di right to take dat kain step as e fit dey necessary to protect di securiti and safe operation of im platform, wey include to dey pause operations of di digital kain moni(es) for some time, and oda steps wey dey necessary. Paxful go use im responsible efforts take give you notice of im ansa to any material changes wey dey operate dey subject to our sole discretion wey include say e fit decide not to support any new fork abi oda actions. You gree and accept di risks of changes wey dey operate for Digital Assets' protocol and gree say Paxful no dey responsible for dat kain changes wey dey operate and no dey liable for loss of value wey you fit experience sake of changes for rules wey dey operate. You gree and accept say Paxful get di sole discretion to sabi im ansa to any change wey dey operate and say we get no responsibility to helep you with protocols abi kain moni wey no dem no support.
    4. As you dey use our services, you fit see content abi utilize Services wey anoda pesin dey bring, wey include hyperlinks to anoda pesin websites and services of dat kain pesin ("3rd party content"). We no dey endorse, adopt abi control any 3rd party content and go get no responsibility abi liability for dat kain 3rd party content whatsoeva. To add join, your dealngs abi correspondence with dat kain pesin just dey between you and di pipo dem. We no dey responsibly abi liable for any loss abi damage of any kain wey you incur sake of result of any of dat kain dealings and you undastand say as you dey use 3rd party content, and di way you dey follow di oda pipo tok, dey only for your own risk.
    5. To avoid doubt, Paxful no dey give investment, tax, abi legal advice. Paxful no regista with di U.S. Securities and Exchange Commission and no dey give securiti services abi investment advice. All wetin you don buy abi sell ontop Paxful thru our platform na ontop padi-to-padi basis wey dey between pesin wey dey sell and pesin wey wan buy and you dey responsible to sabi whether any investment, investment strategy abi wey follow wetin you don buy abi sell if e dey appropriate for you base on your pesinal investment objectives, financial circumstances and risk tolerance. You go nid tok to your legal abi tax professional as regard your particula situation. From time to time, we fit give educational info about our platform and products dem, in oda to helep pipo sabi plenti tins about our services. Info fit include, but no be only blog posts, articles, links to 3rd party content news feed, tutorials and videos dem. Di info wey dey di website abi any oda pesin site wey no constitute investment advice, financial advice, advice to dey buy abi sell, abi any oda kain advice, and you no go treat any of di website content like dat. Before you begin dey sabi if you wan buy, sell, abi hold any Digital Assets dem, make you go conduct your own and consult you financial advisors dem before you begin dey make any investment decision. No go hold Paxful responsible for di decision to make to buy, sell abi hold Digital Assets dem base on di info wey Paxful give.
    6. You gree say we no dey liable for any price wey dey go up and down for Digital Asset. For di event of market disruption abi a Force Majeure event (as dem describe am for section 17), we fit do one abi plenti of wetin follow: (a) pause access to service; abi (b) no let you finish any action thru di services. We no go dey liable for any loss wey you don suffer sake of dat action. To dey follow dat kain event, wen service resume, you gree say rates wey dey market dey differ well well from di rates wey dey available to dat kain event.
    7. We no dey make warranty say di Website, abi di server wey dey make am available, dey free of virus dem abi mistakes, say im contents dey accurate, say dem no go interrupt am, abi say dem go correct di defects. We no go dey responsible abi liable to you for any kind, from any action wey you take, abi don take for reliance for material, abi info, wey dey for di Website.
  6. RELEASE OF PAXFUL & INDEMNITY

    1. If you get fight with one abi plenti pipo wey dey use our services, you release Paxful, im affiliates and pipo wey dey give service and each of im or dia respective officers, directors, pipo wey follow dem work, agents and representatives, from any and all di claims, demands abi damages (actual and consequential) of everi kind nature wey dey arise out of abi in any way connect with dat kain fight. You gree to indemnify and hold Paxful, im affiliates and each of im abi dia respective officers, directors, pipo wey follow dem dey work, agents and representatives, harmless from any claim abi demand ( wey include attorney' moni and any fine, fees abi penalties wey regulatory authority impose) wey come from abi don relate to your breach of im Agreement abi as you no follow any law, rule abi regulation, abi di rights of any oda pesin.
  7. WETIN YOU DON BUY ABI SELL FOR PAXFUL PLATFORM

    Di Website dey let pipo dey ask for offers to buy abi sell Digital Assets.

    Wen a user begin buy abi sell mek en buy abi sell Digital Assets, di buy abi sell go happun based on dis Agreement and to di oda terms, if any dey, wey di user abi di user’s counterparty explain. You fit find step-by-step guide for how to dey buy and dey sell Digital Assets for Paxful Marketplace for https://support.paxful.com/support/solutions/150000191612.

    Di general terms wey follow apply to everi tin wey you don buy abi sell wey dem describe for down:

    1. To dey buy Digital Assets thru dey ask for offer.

      Wen you wan buy Digital Assets for Paxful Platform:

      1. E no get any fees for Paxful Escrow as part of buy abi sell wey don happun wey Pipo wey dey buy for awa Marketplace fit pay.
      2. Offers from Paxful counterparties get dia own how we take dey operate and evvri offer go dey differen for exchange rate, speed of exchange, and oda way wey di Seller wan take dey operate. By to dey gree for Pesin wey dey sell offer you gree join how dat offer take dey operate. How di pesin wan take dey operate dey valid for evri cases except wen dem contradict or break dis Agreement, dey illegal, dey unreasonable or hard to do (as dem tok for Paxful’s sole and absolute discretion), abi if di two users wey dey do di buy and sell gree to change thow dat offer take dey operate. NA YOUR RESPONSIBILITY TO CAREFULLY READ HOW DI PESIN WEY DEY SELL DI OFFER WAN DEY OPERATE AND FOLLOW AM EXACTLY. IF YOU NO FOLLOW HOW DEM DEY TAKE OPERATE, DEM NO GO COLLECT YOUR MONI. NO SEND MONI UNLESS YOU DON FOLLOW EVRI TIN WEY DEM TOK SAY DEM WANT FOR DI OFFER. IF YOU SEND MONI WEN YOU NEVA FOLLOW HOW DEM TOK SAY DEM WANT AM, PAXFUL NO GO HELEP YOU FOR WAY WEY DEM DEY SETTLE FIGHT MEK YOU FOR COLLECT YOUR MONI BACK.
      3. Payment confamation and to dey tok how to unlock Digital Assets from Paxful Escrow na di complete work of di Pesin wey dey sell and nobi Paxful. If di Pesin wey dey sell does no wan release di Digital Assets giv you afta dem don finish wetin Person wey wan sell want, report di issue quick via di dispute button wey deym put inside dat particular buy abi sell tok. Paxful support go check am and settle di fight. Dem dey explain dis way wey dem dey take settle fight under for “Section 8 - To dey report Wetin you don buy abi sell Via Paxful Way dem dey take Settle Fight.” If you no follow dis way dem dey take settle fight, Paxful no go fit helep you for dis matter.
    2. To dey sell Digital Assets

      Wen you dey sell Digital Assets for Paxful Marketplace:

      1. Pipo wey dey sell must confam come process the moni for enuf time, and for som amount of time as dem tok for wetin una agree for di offer. Once Pesin wey dey buy don send moni giv you as e join di with wetin una agree for di offer, na your sole duty and responsibility to confam and process di payment on time and den unlock di Digital Assets from Paxful Escrow and release am giv Pesin wey dey buy. If you no follow how di person talk say im want am for di offer, you fit no get pawa get your Digital Assets wey dem lock back.
      2. As Pesin wey dey sell you dey gree evri risks and liabilities for any break of dis Agreement wey go dey via di sale of Digital Assets. Evri taxes way dem go pay na your responsibility. Paxful dey charges you moni as Pesin wey dey sell Digital Assets for dey lock Digital Assets for Paxful Escrow wey dem nid sell. Unless Paxful’s sole and absolute discretion tok anoda tin, Paxful no go pay any tin wey di Pesin wey dey sell loss weda weda na sake of say dem break of dis Agreement, thief or otherwise and we no go refund awa fee for any circumstances.
      3. Dem go nid process and confam any payment wey you receive before dey unlock di Digital Assets for Paxful Escrow. Paxful mo dey responsible for your loss if you prematurely unlock Digital Assets before dem don confam payment well and say you don recieve am. You must dey attentive and dey ansa your Pesin wey dey buy. You go off any offer wey no dey active.
      4. Any advertisement wey be for your own website for any section for Paxful’s Marketplace (like your bio, wetin una agree for di offer abi tok for wetin u don buy abi sell) wey go cos to dey buy abi sell Digital Assets outside Paxful’s Services dey strictly prohibited. In som kain instances, dem fit gree mek you share your website wey dem mek solely mek di Pesin wey dey sell to collect moni mek e complete wetin you don buy abi sell (i.e. to dey process third party debit/credit card wey dem trust) for how di pesin wey dey buy abi sell talk say im want am; provided say dem tok say dem go use such external websites for di wetin una agree for di offer and d kain websites fit contain any oda advertisements or your contact info.
    3. To Gree

      1. Paxful and di Services no dey affiliated or join with, abi dey endorsed abi sponsored by any third party, plus nobi onli limited to any gift card issuer. Designated trademarks, brands, and oda identifiers na solely properti of pipo wey get am. Paxful and en Services no dey endorsed, sponsored, join abi affiliated for any way by or with dos kain pipo wey get am.
      2. Paxful nobi gift card vendor wey get license abi authorized dealer for any gift card issuer. Any gift cards you dey get directly from a user for di Paxful Marketplace dey under how we dey take operate for third-party merchant wey dey fit redeem am (“Issuer”). Paxful no dey responsible for wetin any Issuer(s) do abi no do, abi any moni, expiration dates, penalties or how we take dey operate wey join di Issuer’s gift card wey en collect for di Paxful Marketplace. By to dey recieve di gift card from user, you dey gree say you don how we take dey operate di gift card, and represent for Paxful say you dey eligible to use di kain gift cards for di how di gift card Issuer take dey operate, abi under applicable law.
      3. WE NO DEY GREE BROKERING ABI RESELLING OF GIFT CARDS ATALL FOR AWA WEBSITE AND MARKETPLACE. YOU MUST BE DI MAIN PESIN WEY GET DI GIFT CARD AND WEN PAXFUL ASK FOR AM YOU GREE TO GIV PAXFUL VALID PROOF SAY NA YOU GET YOUR GIFT CARD (LIKE RECEIPT). PAXFUL NO DEY CLAIM, REPRESENTATION ABI GUARANTEE SAY ANY THIRD-PARTY WAY WEY DEM TAKE PAY FOR DI WEBSITE DEY GREE MEK DEM USEAM BUY ABI SELL VIA PAXFUL’S SERVICE, ABI SAY ANY THIRD-PARTY WAY WEY DEM TAKE PAY FOR AWA WEBSITE DEY SUPPORT ABI DEY SUPPORTED BY AWA SERVICES. YOU NO SUPPOSE USE DAT KAIN THIRD-PARTY WAY WEY DEM TAKE PAY FOR PAXFUL IF DAT KAIN THIRD-PARTY DOES NO DEY GREE FOR AM
      4. NA ONLY YOU DEY RESPONSIBLE TO FOLLOW ALL DI LAWS AND REGULATIONS FOR DI JURISDICTION(S) FOR WIA WETIN YOU DON BUY ABI SELL TAKE HAPPUN.
      5. All wetin una dey buys abi sel go happun ontop Paxful. Dem no dey gree to dey take wetin una dey buy abi sell go outside Paxful Platform abi to dey change outside contact details.
    4. Limit of transfer. We fit, on our own, put limit abi restrict di size, type abi mannar of any transfer of wetin una don buy abi sell wey una wan do, like limit di total amount of Digital Assets wey dem fit don post for sale.
    5. Guarantee no dey. Paxful no dey guarantee say you go fit sell Digital Asset for im Platform. To dey buy abi sell Digital Assets thru Paxful Platform no guarantee say you go fit buy abi sell Digital assets thru di Platform lata.
    6. Relationship. Nothing dey for dis Agreement wey wan do any partnaship, joint venture, agency, consultancy abi trusteeship, you and Paxful dey give respect to one anoda as contractor wey dey independent.
    7. Info wey accurate. You dey represent and warrant say any info wey you bring thru services dey accurate and complete. You accept and gree say Paxful no dey responsible for any mistake abi omission wey you make wey connect with any tin wey una buy abi sell thru di services, for instance, if you do mistake for address of online purse abi you bring info wey no correct. We go tell you to review di details of tins wey una dey buy abi sell well well before you complete dem thru di services.
    8. No Cancellations abi Change; Wallet Activities. Once dem don submit info for buy abi sell wey don happun go di digital currency network via di Services, Paxful no go fit helep you to cancel abi otherwise change your buy abi sell wey don happun. Paxful no get pawa over any digital currency network and no go fit run any cancellation or change requests. Paxful no dey kip abi save any Digital Assets wey dem lock. Dem dey always record Digital Assets for dia separate networks abi blockchains. Evri digital currency buy abi sell dey happun inside di digital currency network, nobi for Paxful. E no get guarantees say di buy abi sell go process for di digital currency network. Paxful get right mek no gree process any buy abi sell if e dey required by law abi if we see say di buy abi sell dey against how we take dey operate for dis Agreement. You dey gree and acknowledge say you take full responsibility for evri tin wey dey happun for your Wallet and dey gree for evri risks of any authorized or unauthorized access for your Wallet, reach di level wey high pas for law.
    9. Taxes. Na your responsibility to determine wetin, if any, taxes dey for di buy abi sell wey don happun for wey you don submit buy abi sell wey don happun info via di Services, and na your responsibility to report and remit di correct tax giv di correct tax authority. You gree say Paxful no dey responsible to determine weda taxes dey your digital currency buy abi sell abi for to dey collect, to dey report, to dey hold or to dey comot any taxe wey go dey for any digital currency buy abi sell.
    10. User Reputation. Wen you run Buy abi sell, we dey gree mek oda users reply sake of how dem follow you do am. We dey also gree mek users file reports if di users reason say you don fail for dis Agreement in any way. Dis reports dey confidential, but we fit use am join any fight as dem tok am for Section 8.
    11. Tins wey you don buy abi sell wey don pass. You fit look di tins wey you don buy abi sell wey don pass thru your Account. You gree say di Services fail to give confamatoin wey no fit do bad abi no make dat kain rules of wetin una don buy abi sell no validate.
    12. Paxful Day. Paxful don give merchants authority to accept some kain way wey dey to take pay for di goods and services dem wey dem buy online (di "merchants wey get authority"). You fit pay merchant wey get authority by say you choose "Paxful Pay" as di way for check-out for di time to pay. Paxful Pay go direct you go our Platform to access di Digital Asset wey dey your account abi connect you give pesin wey dey sell. If you buy Digital Asset from pesin wey dey sell to finish wetin una dey buy abi sell, di rules set forth for section 7.1 of dis Agreement go apply.
    13. Merchant Goods. Paxful no dey responsible for any goods abi services wey you fit buy from merchant wey get authority wey dey use your acount abi di Paxful Pay product. If you get fight with any merchant wey get authority, make you settle di fight direct with di merchant wey get authority.
    14. Returns, Refund. Wen you buy good abi service from anoda pesin wey dey use your account, na final. We no dey return moni. Merchant wey get authority fit offer you return, store credit abi gift card if im wan do am and as e follow di policies.
    15. Paxful dey collect moni for Services, dem go show applicable fees giv you before you begin use any Service wey moni dey inside. Luk “Paxful Fees” for oda info. Awa fees fit change and Paxful get right to change en pricing and fees any time.
  8. TO DEY FIGHT WETIN YOU DON BUY ABI SELL DEM THRU PAXFUL PROCESS TO SETTLE FIGHT

    1. To dey report Wetin u don buy abi sell. For som kain cases, way wey easy pas to settle fight na mek Pipo wey dey buy and Pipo wey dey sell tok, work togeda to sabi wetin happun, and come gree for solution. Wen a Pesin wey dey buy and Pesin wey dey sell no fit gree for solution, Paxful’s support team (“Paxful Support”) fit helep. Any of di party fit begin di process to settle fight (“wetin pesin don buy abi sell wey get problem” abi “fight”) wey join wetin pesin don buy abi sell. Dem fit begin report wetin u don buy abi sell wey Pesin wey dey buy don mark as don pay finish. Dem no fit report, reverse, abi change wetin u don buy abi sell wey Pesin wey dey buy no mark as don pay finish, wey Pesin wey dey buy don cancel, wey cancel automatically sake of say timeframe wey dem fix for offer don expire, wey de don already report and come settle or wia be say di Pesin wey dey sell don release di Digital Assets giv Pesin wey dey buy.
    2. Process to settle fight. Steps wey Paxful support take dey settle fight for down.

      1. Initiation

        You fit begin to report by to dey enta your Paxful Account, open wetin u don buy abi sell wey you go like report and to dey chus di “fight” button. Di “fight” button go onli show active if Pesin wey dey buy don mark wetin u don buy abi sell as don pay complete. Once you begin report, you go chus di kain report from di options wey dey and explain di issue wey mek you report.

        Di ways wey you go take describe your fight if you be pesin wey dey sell dey for down:

        • Coinlocker (dat na pesin wey wan buy wey no dey ansa) - di pesin wey wan buy don mark wetin una dey buy abi sell as don pay finish, but no dey ansa and no dey do anytin.
        • Issue wey dey with moni - di pesin wey wan buy dey active and don try to pay but issue dey with di moni.
        • Oda - open way wey you fit describe wetin cos di fight. Di pesin wey wan buy go fit see wetin you describe.

        Di ways wey you go take describe your fight if you be pesin wey wan buy dey for down:

        • Vendor wey no dey ansa - you don pay, but pesin wey dey sell no dey ansa and no dey do anytin.
        • Issue wey dey with moni - you don pay, but pesin wey dey sell tok say issue dey with di moni and no wan release di Digital Assets.
        • Oda - open way wey you fit describe wetin cos di fight. Di pesin wey dey sell go fit see wetin you describe.
      2. Mesage

        Wen una don submit di fight, Paxful Support go give di oda pesin mesage by email and go send mesage thru di feature of tok for wetin una dey buy abi sell wey dey available to pipo wey dey buy and pipo wey dey sell for di Platform wey dey tell di pesin say fight don begin. If one of wetin you dey buy abi sell dey di fight, Paxful support go tell you which one dey di fight and why.

      3. Ansa

        Review di fight and give Paxful support explanation of wetin happun. Add any evidence wey you get to support wetin you explain, like proof of moni wey you pay, proof say na your own, abi proof say you don see abi neva see di moni wey dem pay.

      4. Paxful Review

        Paxful Support go investigate wetin u don buy abi sell wey dem report dem go make decision based on evidence wey di two parties giv. Paxful Support dey settle fight by to dey check plenti factors as dem tok for under Section 8.

    3. To dey check Fight. Wen dem dey check fight, Paxful Support fit tell you how dem want am wey you go follow. Wetin dem want wey dem tell you fit nid mek you giv anoda evidence, like ahoda ID confamation, document wey show say u don pay, any foto, audio, or video evidence, abi any oda documents wey Paxful feel say dey okay and fit nid mek you giv di kain evidence inside specified time. If you no follow how dem talk say dem want am fit cos mek dem settle di fight against you. Paxful Support go giv u notice of wetin en gree via tok feature for wey wetin u don buy abi sell for Marketplace inside 30 days of to dey get di report, but for some circumstances, e fit long pas.
    4. No dey ansa. Wen you dey run buy abi sell, e dey important say you dey active and available from di time way di buy abi sell begin go di time wey wetin u don buy abi sell don complete, cancel, abi don settle. E mean say you must be able to reply request by Paxful Support for wetin u don buy abi sell wey cos fight inside di time wey Paxful Support tok or dem fit reason say you no dey ansa come settle di fight against you.
    5. Chargebacks. A party fit face oda risks depending on di way dem take pay for wetin dem don buy abi sell even if Paxful process wey dey settle fight side di kain party. Di process wey dey settle fight wey dey dis Agreement dey separate from any remedies Pesin wey dey buy abi Pesin wey dey sell fit get via di way wey dem take pay wey join wetin dem don buy abi sell. Paxful no get hand to begin abi handle chargebacks and e no dey liable if one party reverse, charges back, abi report wetin dem don buy abi sell via a way wey di party make via di way dem take pay for wetin dem don buy abi sell, plus afta dem don close fight.
    6. To dey settle Fight. Paxful Support dey settle wetin pesin don buy abi sell wey dem report evri time by to dey move di Digital Assets as e join di fight for Pesin wey dey buy or Pesin wey dey sell wey get di buy abi sell wey dem report once di process to settle di fight complete.

      For under na som kain situations wey we chus to explain giv you as how Paxful fit settle wetin u don buy abi sell wey dem report. Dis list no suppose kari evritin. Som particular facts wey join di fight and evidence wey users giv dey affect how dem dey settle any fight.

      Paxful support fit settle di fight give pesin wey wan buy wen d fight don meet at least one of wetin follow:

      • Pesin wey dey buy don pay moni based on how di person wey Sell talk say im want am before based on di offer for wetin dem don buy abi sell and the Pesin wey dey buy don giv beta proof say di dem pay di moni as how di pesin talk say im want am. Na violation of dis Agreement for Pesin wey dey sell to no go finish buy abi sell wey dey happun once di Pesin wey dey buy don finish evri tin wey Pesin wey wan sell want as dem post for di time wen di Pesin wey dey buy gree come pay for di buy abi sell.
      • Di pesin wey dey sell no dey ansa and neva bring beta ansa inside di time wey Paxful support request.
      • Di moni wey dem pay to di oda pesin for wetin una don buy abi sell abi di moni wey go account wey neva regista for di name of pesin wey dey sell.

      Paxful support fit settle di fight give pesin wey dey sell wen d fight don meet one of wetin follow:

      • Di pesin wey dey buy neva pay yet, neva bring full moni abi neva bring moni wey follow wetin pesin wey dey sell tok for di offer wey im wan buy abi sell.
      • Pesin wey dey process moni don hold, pause abi stop di moni wey pesin wey wan buy pay. E include wen di pesin wey wan buy don do chargeback abi don fight for moni thru bank abi di pesin wey dey give card to take pay.
      • Di pesin wey wan buy no dey ansa and neva bring beta ansa inside di time wey Paxful support request.
      • Di moni wey di oda pesin pay for wetin una don buy abi sell abi di moni wey come from account wey neva regista for di name of pesin wey wan buy.

      If di pesin wey wan buy abi pesin wey dey sell bring fake info abi fake documents for fight wey dey for wetin dem don buy abi sell abi tok fake tins abi use lie lie way, di fight fit settle against dat kain pesin and dem go pause dat pesin account now now abi close am, na for Paxful support mind e dey.

      For some kain situations wia no one dey do wetin dem suppose do, abi for oda ways wey no clear abi no dey possible to sabi which party don do wetin im suppose do for di fight to settle dey for Paxful mind, Paxful fit decide to share di Digital Asset equal abi make e no equal between pesin wey dey sell and pesin wey wan buy to take settle di fight.

    7. Appeal. If you believe say Paxful don settle fight for way wey no follow for dis Agreement, you get right to ask for appeal. To ask for appeal, you nid tell us quick for writing by to dey contact Paxful support wey dem dey give customer wen e neva pas 10 calendar days afta dem don send you notice of Paxful Support’s decision come give beta details and evidence wey dey support your case for request. Your appeal suppose tok how you think say Paxful no settle di fight well as per rules wey dey dis Agreement come giv evidence of di kain decision wey no correct.

      Abeg sabi say weda for di fight or generally any time wen you dey use awa Services, you go nid dey tok normal and respect oda users and Paxful Support. Luk generally for, “Section 13 - Prohibited Use”.

    8. Las las. You sabi and gree say Paxful’s decision wey consaign fight na final and dey binding as dem tok am for dis Agreement. Paxful no go kari loss for either pesin wey dey Buy ab pesin wey dey Sell we join wetin im decide.
  9. FEES TO DEY USE PAXFUL SERVICES

    1. To open Wallet na free. Paxful dey collect moni for Services, dem go show applicable fees giv you before you begin use any Service wey moni dey inside. Luk “Paxful Fees” for oda info. Awa fees fit change and Paxful get right to change en pricing and fees any time.
  10. NO GET RIGHT TO CANCEL SERVICE ABI MINERS FESS

    1. If you use Service wey charge dey, or you begin buyb abi sell with a miner fee via di Services, you no go dey eligible for refund or reimbursement once you don confam say you wan go on with di Service or buy abi sell.
  11. NO CONTINUE SERVICES AGAIN

    1. We fit, in by awasef and no cost for you, with abi without prior notice and any time, change or no go on, for small time abi permanently, any part of awa Services.
  12. TO PAUSE ABI TO STOP SERVICES DEM & ACCOUNT; DEY LIMIT ACCESS TO YOUR ONLINE PURSE

    1. We fit by awa sole and absolute discretion, immediately and no tok am before taim: (a) pause, block, abi stop your access for any abi all of di Services (plus stop you to enta your Wallet), and/or (b) off abi cancel your account if: (i) we dey ask by applicable law, subpoena wey dey facially valid, court order, abi government authority order wey dey bind; (ii) we dey suspect say you don or fit act in violation for dis Agreement; (iii) to dey use your account dey subject to any litigation, investigation, or government proceeding wey dey pending and/abi we dey notice high risk of legal or regulatory non-compliance wey join for your account activity; (iv) pipo wey dey follo awa service no fit support your use; (v) you dey do sometin wey we see sey dey doge awa controls and how we dey do tins abi (vi) we dey reason say e dey necessary to do am take protect us, awa users, plus you, or awa employees comot for danger or loss. If we show awa rights to limit abi no gree enta di Services, we no go dey responsible for any consequences wey awa refusal to gree enta di Services fit cos, plus any delay, damage or inconvenience you fit suffer sake of am.
    2. Ohow we pause abi close your account, stop you to dey use di Services for any reason, or no gree you enta your Wallet, we go try send you info for wetin we do except say court order or oda legal process no gree us to dey giv you di kain info. YOU GREE SAY AWA DECISION TO DO SOMKAIN TINS, PLUS TO NO GREE MEK, TO PAUSE, ABI CLOSE YOUR ACCOUNT ABI WALLET, FIT BE SAKE OF CONFIDENTIAL MATA WEY DEY ESSENTIAL FOR AWA RISK MANAGEMENT AND SECURITY MATA. YOU GREE SAY PAXFUL NO GET ANY LAW TO SHOW INFO FOR EN RISK MANAGEMENT AND SECURITY MATA GIV YOU. Wia e be say we pause your account or mek unno enta your Wallet, we go comot di suspension quick once wetin cos di suspension no dey again, as e be we o get any law to tell you wen (if e dey) we go comot di kain suspension.
    3. If you get Digital Assets for your Paxful Wallet and e neva get any activity for your account for som kain time wey dem tok for applicable law, we fit report di Digital Assets wey remain for your account as property wey pesin no fit claim as e dey for law for property wey dem abandon and escheat. If e happun, we go use evri way wey we fit send you written notice. If you no ansa di kain notice inside seven (7) business days wey you get, abi as dem tok for law, we fit send di kain Digital Assets giv applicable jurisdiction as property wey pesin no fit claim. We get right to comot dormancy moni abi oda administrative charges from di kain Digital Assets wey person no fit claim as dem tok for applicable law.
    4. We reserve the right to reverse internally received Digital Assets to your Paxful Wallet back to the originating account if the owner of the originating account successfully demonstrates that the Digital Assets were transferred to your Paxful Wallet in error, and if there has been no activity in your account for a period of 24 months. If this occurs, we will use reasonable efforts to provide written notice to you. If you fail to respond to any such notice within 14 days, we may be required to reverse Digital Assets to the owner of the originating account.
  13. DEM NO GREE USE

    1. Wen u dey enta or dey use di Services, you gree sey you go use di Services for how we take dey operate am for dis Agreement (plus di Rules wey dey guide awa Privacy) and no do any bad tin, and that you dey solely responsible for wetin you do wen you dey awa Services. No comot di generality of wetin dey happun, you gree say you no go:
      1. use awa Services for any way wey fit interfere with, spoil, negatively affect or inhibit oda pipo wey dey use paxful from to dey enjoy awa Services complete, or wey fit spoil, off, overburden abi spoil how awa Services dey work in any manner;
      2. follow for any activity wey fit cast, abi join cast, any law, statute, ordinance, or regulation, sanctions programs wey dem put for kontri wia we dey do awa business or operations, or wey go involve proceeds of any activity we no dey law; publish, distribute or share any material or info wey no dey law;
      3. clash wit how anoda user’s wan enta abi use any of awa Services; defame, abuse, thief, harass, stalk, threaten or otherwise violate or cast oda users legal rights (like, but nobi onli, rights for privacy, publicity and intellectual property); incite, threaten, helep, promote, abi encourage hate, racial intolerance, abi fight against oda pipo; harvest or otherwise collect info for awa Website for oda users;
      4. follow for any activity wey dey thief, defame or otherwise cos damage for Paxful or awa users; or giv info wey be lie, no correct, deceptive or misleading to Paxful abi anoda user wey join awa Services or as dem giv abi request wey consaign dis Agreement;
      5. kari come for di Services any virus, Trojan, worms, logic bombs abi oda material wey fit cos problem; use any robot, spider, crawler, scraper or oda automated way or interface wey nobi we givtake enta awa Services abi collect data; try corner any wey to take sieve infomate we dey use, or try enta any service or area for awa Services wey you no suppose enta; or placement anywia inside Paxful’s Marketplace for any advertisement abi promotion wey go high to dey buy abi sell Digital Assets outside Paxful’s Services;
      6. follow for wetin u don buy abi sell wey get items wey dey break or violate any copyright, trademark, right of publicity abi privacy abi any oda proprietary right for di law, abi oda licensed materials wey no get correct authority for di pesin wey get di rights; to dey use of Paxful intellectual property, name, abi logo, plus to dey use Paxful’s buy abi sell or service marks, wen you no get written consent before for awa hand abi for way wey dey spoil Paxful abi Paxful brand; any action wey bi lie lie endorsement by abi join with Paxful; or develop any third-party applications twey dey interact with awa Services wen you no get written consent before; abi
      7. encourage abi force any anoda pesin mek dem do any of di tins wey dem no gree unda dis Section 13.
  14. INTELLECTUAL PROPERTI RIGHTS

    1. We dey giv you license wey dey limited, nonexclusive, no fit transfer, basde on how we take dey operate for dis Agreement, to enta come use di Services, Website, and related content, materials, infor (combine, di “Content”) solely for purposes wey Paxful approve from time to time. We no dey gree any oda use for di Website abi Content atall and evri oda right, title, and interest for di Services, Website or Content na exclusively Paxful property. You gree you no go copy, send, share, sell, license, reverse engineer, change, publish, or follow for di transfer abi sell, mek derivative works from, or anoda way thief any of di Content, complete or in partwen you no get Paxful written consent. You no go fit copy, imitate or use any of Paxful’s trademarks, registered marks, logos or any of en intellectual property wen you no get Paxful’s written consent before.
    2. Although say we dey reason to giv correct and info wey be on time for Paxful Website, awa Website (plus, wey no get limitation, di Content) fit no always dey correct, complete abi current and fit also get technical inaccuracies abi typographical errors. As we dey try to dey continue to giv you info wey dey complete and correct as possible, information fit change or update from time to time without notice, plus without limitation info wey rules wey dey guide us, products and Services. Laidat, you go nid confam evri info before you dey trust am, and evri tin you gree based on info wey dey di Paxful Website na your sole responsibility and we no go get liability for dat kain decisions. Info wey third party dey giv na for informational purposes onli and Paxful no dey giv warranty sy e correct. Dem fit drop link for dis third-party materials (plus wey nobi onli, websites) mek e easy but nobi we dey control am. You dey gree say we no dey responsible for any kain info, content, or Services wey dey any third-party materials abi for any third-party sites wey pesin fit enta abi wey join for Paxful Website.
  15. REPLY AND WETIN USER SUBMIT

    1. Paxful dey always find way to mek en Services and Website beta. If you get ideas abi suggestionswey consaign beta abi wey dem go join for Paxful’s Services abi for di Website, Paxful go like hear am; sha, any submission go be based on how we take dey operate for dis Agreement.
    2. For no reason go mek leaking of idea abi reply, abi any material wey join Paxful or any of en subsidiaries, parents or affiliated companies, abi any of dia officers, directors, oga, members, shareholders, employees and agents, or any of dia heirs, successors, representatives and assigns (wey evri one na “Paxful Party” and combine na, di“Paxful Parties”) dey for any law of confidentiality abi dey expect to get compensation.
    3. By to dey submit idea or reply abi any material wey join am wey go dey subject to intellectual property rights (di “Work”) for Paxful abi any Paxful Party, you giv Paxful, based on di Work wey dem submit, non-exclusive, perpetual, worldwide royalty free license you go use for evri content of di kain ideas and reply, for any kain reason atall. Plus, you dey doge any moral rights go di level wey pas wey dem gree for United States law wey you fit get for Work and dey represent and dey warrant di kain Paxful Party say di Work dey original for your hand, say nobodi else get any rights for di Work and say evri Paxful Parties dey free for any royalty to implement di Work come use di material wey join am if dem desire, as dem provide or as dem change for any Paxful Party, no get permission or license for any third party.
    4. You dey gree say Paxful fit sub-license any of di Paxful Parties to use am for any way any Work and material wey you don submit.
    5. We get right to comot any posting you fit mek for di Website, for awa absolute discretion, with no warning abi reasons.
  16. HOW E GO CONTACT US

    We dey advice mek you visit awa FAQ page before you follow us tok. For wen di FAQ page no get di info you dey find, Paxful dey giv 24/7 support. You fit call us via awa support widget wey dey di FAQ page.

  17. FORCE MAJEURE

    1. We no go dey liable for delays, failure for performance abi interruption of Service wey go result directly or indirectly go cause or condition pas awa reasonable control, plus nobi onli, significant market change, any delay abi failure sake of wetin God do, civil abi army men doings, act of terrorists, civil problem, war, strike abi oda labor fight, fire, pause for telecommunications or Internet services or network provider services, equipment failure and/or software, oda catastrophe abi any oda tin wey happun wey pas awa control and wey no affect di validity and enforceability of any provisions remaining.
  18. KAIN AGREEMENT

    1. Dis Agreement get di complete agreement between you and Paxful with respect for di subject matter for di how we take dey operate for dis Agreement and dis Agreement cancels and pas any understandings and agreements wey dey before between you and Paxful wey consaign dat subject matter. You no fit assign any of your rights abi obligations for dis Agreement wen you no get awa written consent.