Paxful, Inc. Privacy Notice

Paxful, Inc. (wey dem dey also call “Paxful,” “we,” “us,” or “awa”) dey take steps to protect your privacy. For dis Privacy Notice (“Notice”), we dey tok di kain info about you we fit collect from you wey join with how you use of awa websites plus, but nobi only, https://paxful.com/, di Paxful Wallet, na awa online bitcoin buy abi sell platform, mobile application, social media pages, or oda online properties (collectively, di “Website”), or wen you use any of di products, services, content, features, technologies, or functions we dey give (collectively, di “Services”).

Dem mek dis Notice to helep you get info about awa privacy practices and to helep you sabi your privacy choices wen you use awa Website and Services. Abeg sabi say awa Service offerings fit change by region.

For all purposes, di English language side of di privacy notice go be di original, govaning instrument. If at all di English language side of di privacy notice and any oda language wey dem translate to no dey relate well, den na di English language side go govan and control.

Pesinal info wey we collect

We dey collect info wey consaign you (“Info about Urself”) wey join how you use di Website, awa Services. or otherwise wey join awa relationship with you. Di kain Info about Urself wey we may get from you fit include:

Biographical info, wey include:

  • Name
  • Email Address
  • Fone numba
  • Countri
  • Full Address
  • Date wey dem born you

Paxful Account Details, wey include:

  • Pesin name
  • Pesin wey dey use am Profile Info for di “Bio” side
  • Online picture
  • Date wey dem don join
  • Kain moni wey we give you
  • Time Zone
  • Language wey we give you

Tins wey you don do for your Paxful account, wey include:

  • Message dem for di Buy abi sell Tok (wey fit get info wey consaign moni if you givam to pipo wey dey buy abi sell)
  • Attachement wey dey di Buy abi sell Tok
  • Tins wey happun for Buy abi sell
  • Buy abi sell wey don happun
  • Affiliate Name
  • Affiliate ID
  • Affiliate Link
  • Wetin Affiliate don buy abi sell
  • Offer wey Don dey
  • Rules of di Offer
  • Wetin di pesin wey dey buy abi sell tok say im want for im Buy abi sell
  • Account Message
  • Account Status

Data wey consaign your Digital asset wallet, plus:

  • Key wey Nobi for everibodi
  • Key wey Be for evribodi
  • Wetin remain for online purse
  • Don get Wetin u don buy abi sell
  • Don send Wetin u don buy abi sell

Collect Data wey join with “Sabi Ur Customa” (KYC) Law, plus:

  • ID wey Government giv
  • Proof of Wia you dey
  • Foto, if you chus to send am giv us
  • Video, if you chus to send am giv us

Data for how you dey use Device and Website, wey include:

  • IP Address
  • Cookie ID and/abi oda device identifiers
  • Inform wey consaign how you dey enta di Website, laik device characteristics, date & time
  • Language wey you fit chus
  • Info for tins wey you do wen you dey use di Website

Data wey be for mobile application, wey include:

  • Session data: IP address, version of di operating sysytem, brand and model of di device, unique identifiers of di device, browser wey you don use, info about di time wey dem access di application, name and parameters of di network connection.
  • Info about di application wey don install for di pesin device (metadata wey come from applications): application name, application identifier and version, device identifier and checksum. Di reason why we dey collect info about apps wey don install for your device na to dey see malicious apps and dey protect pipo from tiff mata.
  • Info for tins wey you do wen you dey use di mobile application
  • Crash and application errors diagnostics data

How we use your data

Di business reason wey mek us collect, use, kip, and share your Personal Data fit include:

  • To provide Services by to dey operate di Website, plus to:
    • Regista, open, and maintain your account;
    • Confam your identity and/abi how you fir enta an account, or helep pipo wey dey sell confam your identity;
    • Begin, facilitate, run, and/abi finish wetin u don buy abi sell;
    • Follow you tok about your account abi any services wey you dey use;
    • Check if dem fit give you credit, KYC abo oda reviews wey look like;
    • Check applications; abi
    • Compare info for how e take correct and confamtion purposes.
  • Mek e manage risk and protect you, oda pipo, and di Website and Services.
  • To giv you beta experience and confam wetin you chus.
  • Mek you sabi your customa beta pas and how dem dey use and interact with di Website and Services.
  • To market for you.
  • To give your own Services, offers, and promotions for awa Website and third-party websites.
  • To giv you location-specific options, functionalities, and offers.
  • To gree with rules wey dey guide us and obligations, plus, but nobi onli, disclosures and ansa for any qweshon from law enforcement pipo and/abi regulators wey follow for any applicable law, rule, regulation, judicial or government order, regulatory authority of competent jurisdiction, discovery request or similar legal process.
  • To settle fight, collect moni, or find ansa for problems.
  • To giv you customer service abi follow you tok.
  • To manage awa business.

We fit also process Info about Urself for oda purposes based on wetin you gree wen applicable law nid am.

Sources from wia we dey get info about urself

We dey get Info about Urself from some sources, plus

  • Directly from you: We dey collect Info about Urself directly for your hand wen you use awa Website abi Services, follo us tok, or follo wus tok directly.
  • From service providers and/abi data processors wey dey helep us by to dey giv us di Website abi di Services: We fit bring service providers to helep us in mek di Website abi di Services beta for you, for awa direction and on sake of us. Dis service providers fit collect info about you and givam to us.
  • From oda users for Paxful Website abi from affiliates wey dey for di Paxful Website abi Services: Oda pesin wey dey use paxful fit giv us infor about youwey join for wetin u don buy abi sell abi tok. Affiliates fit also giv us info about you wey consaign your your doings or wetin u don buy abi sell with di kain affiliates.
  • From third-parties wey fit helep us confam identity, stop thief, and protect the security of wetin u don buy abi sell.
  • From third-parties wey fit helep us check how dem fit trust you abi level of moni.
  • From third-parties wey fit helep us check Info about Urself, improve di Website abi di Services or your experience ontop am, market products or services, or giv promotions and offers to you.
  • From social media platforms, if you follow us tok via social media.

How we share data

For some kain circumstances, we fit show som kain Info about Urself with oda pipo. Di kain pipo wey we fit share Info about Urself giv na:

  • Service providers and/abi data processors: We fit share Info about Urself with third-party service providers wey dey do tins and functions for awa direction and for us. Dis third-party service providers fit, for example, giv you Services, confam your identity, helep you run buy abi sell, send you advertisements for awa products and Services, or give you support wey dem dey give customer.
  • Oda pipo for wetin una dey buy abi sell, like pesin wey dey sell: We fit share info with di oda pipo for wetin you dey buy abi sell, wey include oda pipo wey you from dey buy di digital asset.
  • Financial institutions and oda companies wey dey involve to dey helep you dey pay wey connect to wetin you dey buy abi sell
  • Affiliates wey dey collect referrals from our Website
  • Oda pipo for our business purposes abi as di law don permit abi don ask of, wey include:
    • To follow with any legal, regulatory abi contractual tins wey you suppose do, abi with any legal abi regulatory process (like court oda wey valid abi subpoena);
    • To mek, do, abi defend legal claims;
    • To ansa request by government agency, like law enforcement pipo abi judicial order;
    • To enforce How we take dey Operate awa Website abi rules wey dey guide us internal;
    • To stop physical harm abi loss of moni, wey join an investigation of suspected or actual illegal activity, or to otherwise protect awa or oda pipo rights, property, or safety;
    • To control buy abi sell of all abi part of Paxful business. For example, dey share info with compani wey we wan join with abi wey wan buy us; abi
    • To support our audit, compliance, and corporate governance functions.

Intanational transfer of info

Abeg note say we fit transfer pesinal info wey we collect about you to countris dem apart from di countri wey we for collect di info. Dose countris dem fit no get di same info protection laws as di countri wey you for give us di info. Wen we transfer your pesinal info to oda countries, we dey take steps wey go make sure say di transfer dey in line with applicable law.

Cookies and to dey advatise online

  • Cookie na small test file wey websites dey save for your computa abi mobile device wen you visit di website.
  • Our website dey use cookies and technologies wey dey track take dey work, and to take target advatising wey you fit like. For oda info, abeg go our Cookie Policy.
  • Paxful fit work with anoda pesin network wey dey advatise to display advat for di Paxful website abi for di oda pesin websites dem. No be Paxful dey control dese websites and anoda pesin advat network. Advat network partnas dem dey use info technologies take collect info about wetin you dey do online to give you target for advat base on your interest. If you no wan make dem use dis info to dey serve you target advat, you fit wan comot by say you visit:

Abeg note say dis one fit no comot you from advat; you go continue to dey collect generic advat wey no base on your specific interest. You fit control di use of Cookies for di individual browser level. If you reject cookies, you fit still use our website, buy your ability to use some featues abi areas of our website fit get limit.

To rememba data

We dey kip pesinal info for di period wey dey necessary for di purpose wey we collect am for, abi for di period we di law ask us to. Dis fit involve to dey kip pesinal data for time wey follow wen you take buy abi sell. We dey try comot your pesinal info wen e no nid again for any of di business purpose wey dem describe for up.

Info securiti

Paxful don implement safeguards wey dem design to protect your pesinal info, wey include measures wey dem design to prevent loss, misuse, and access wey no get authority and disclosure of pesinal info. Still, Paxful no fit make sure abi warrant di securiti abi confidentiality of info wey you send to us abi collect from us thru intanet abi wireless connection. To dey transfer info thru di intanet dey always come with risk, even if paxful dey make effort to protect info wen e don collect am.

Pikin dem wey neva reach 18years

Paxful Website no be for pikin dem wey neva reach 18. We no dey collect info from pikin dem wey neva reach 18 wey no get confam consent from dia parents. If we sabi say we don collect info, wey include pesinal info, from pesin wey neva reach 18 wey no get consent from dia parent, we go comot dat info quik quik.

Wan correct sometins for di privacy notice

Paxful get di right to change dis notice from time to time. We go tell you di tins wey we wan correct for dis notice wen we dey post di notice wey we don correct for here, by email, abi by means of important notice for di Paxful Website home page. We recommend say make you dey check di websites for any changes from time to time.

Contact us

If you get any qwesion about dis notice, abi wan make inquiry with us about pesinal info abi privacy, abeg contact us for: [email protected]

EEA Addendum

Di disclosure wey dey follow apply to, and na for only, pipo wey dey stay for d European Economic Area (EEA).

Pesin wey dey control info

Di pesin wey dey control your pesinal info na Paxful, Inc.

Legal base to take process pesinal info

  • Di way we dey use pesinal data to do contractual obligations abi request wey you make wey connect with contract, Article6(1)(b) of di General Data Protection Regulation ("GDPR") na di legal base for our data wey we dey process.
  • Di way wey we dey use pesinal data take comply with a legal obligation wey dey unda EU abi Member State law, Article6(1)(c) of di GDPR na di legal base for our data wey we dey process.
  • Di way wey we dey use pesinal data take protect di vital interests of pipo, Article6(1)(d) of di GDPR na di legal base for our data wey we dey process.
  • Di way we dey use pesinal data take follow our business interest wey dey legitimate, Article 6(1)(f) of di GDPR na di legal base for our data wey we dey process. List of our business interest wey dey legitimate for di section wey dey up wey dem call "How We Take Dey Use Your Data".

European Data Protection Rights

European law dey give you some kain rights wey get respect to your Pesinal Data, wey include:

  • Di right to ask for access to and to correct your pesinal info.
  • Di right to ask say Paxful comot some pesinal info wey be for you.
  • Di right to fit port info, wey include di right to ask say make we transfer some of your pesinal info wey you don give us to anoda pesin wey dey control info.
  • Di right to comot any consent wey you don give Paxful to collect, use, abi share your info for any time. Abeg note say to comot consent no affect di law wey say Paxful go process your pesinal info before you comot moni.
  • Di right to object to Paxful to process your pesinal info, base on ground wey dey particula to dis your situation.
  • Di right to request say Paxful restrict di way dem dey process your Pesinal Data, if dem meet some kain statutory conditions dem.
  • Di right to lodge complaint with European Supervisory authority.

Abeg note say dat applicable law fit give exceptions to any of dese rights, permit Paxful to decline your request, abi permit Paxful to extend di period wey e fit act on wetin you request. Paxful fit still contact you to confam who you be, as di law take tok am, before we begin dey act on your request. To do any of dis rights dem, abeg contact us as we tok am for di section wey dey up wey dem call "Contact Us".

Intanational transfer

We fit transfer Pesinal Data wey relate to pipo wey dey stay EEA to countries wey di European Commission neva see to give beta protection, wey include di United States. For any of dat kain transfer, Paxful dey implement safeguards wey dem design to make sure say your Pesinal Data dey get adequate protection level. If you dey stay for di EEA, Paxful go only transfer your Pesinal Data if: di countri wia di Pesinal Data na wia European Commission don grant adequacy decision; di pesin wey wan collect di Pesinal Data dey stay for di United States and don certify to di US-EU privacy Shield Framework; Paxful don put beta safeguards in place for di transfer, for example dey enta into EU Standard Contractual Clauses with di pesin wey wan collect, abi statutory exception wey dey applicable to di GDPR general transfer prohibition wey apply. To get copy of di ways wey Paxful don execute to support im transfer of pesinal data outside di EEA, contact us as we tok am for di section "Contact Us" for up.

California Addendum

Di disclosure wey follow apply to only and na for only pipo wey dey live for State of California.

Your California Privacy Rights

Di fact say we dey tell some kain info wey dey pesinal about you to anoda pesin dem who dey use am for dia own direct purpose to dey market, you get right to request plenti info about di pipo wey dey collect your info. To use dis right, abeg contact us as dem describe am for di section for up, wey dem call "Contact Us"

No Track Disclosure

No design our website to ansa "No track" signals abi request.

Facts What does Paxful do with your personal information?
Why?

Financial companies choose how they share your personal information. Federal law gives consumers the right to limit some but not all sharing. Federal law also requires us to tell you how we collect, share, and protect your personal information. Please read this notice carefully to understand what we do.

What?

The types of personal information we collect and share depend on the product or service you have with us. This information can include:

  • Social Security number or account balances
  • Payment history or transaction history
  • Credit history or credit scores

When you are no longer our customer, we continue to share your information as described in this notice.

How?

All financial companies need to share customers' personal information to run their everyday business. In the section below, we list the reasons financial companies can share their customers' personal information; the reasons Paxful chooses to share; and whether you can limit this sharing.


Reasons we can share your personal information

Does Paxful share?

Can you limit this sharing?

For our everyday business purposes - such as to process your transactions, maintain your account(s), respond to court orders and legal investigations, or report to credit bureaus

Yes

No

For our marketing purposes - to offer our products and services to you

Yes

No

For joint marketing with other financial companies

Yes

No

For our affiliates' everyday business purposes - information about your transactions and experiences

Yes

No

For our affiliates' everyday business purposes - information about your creditworthiness

No

We don't share

For nonaffiliates to market to you

No

We don't share

Questions?

Go to www.paxful.com

Who we are

Who is providing this notice?

The privacy notice is provided by Paxful and is applicable to your personal Paxful account.

What we do

How does Paxful protect my personal information?

To protect your personal information from unauthorized access and use, we use security measures that comply with federal law. These measures include computer safeguards and secured files and buildings.

How does Paxful collect my personal information?

We collect your personal information, for example, when you

  • open an account or provide account information
  • give us contact information or make a transfer
  • use your Paxful account to send or receive funds

We also collect personal information from others, such as credit bureaus, affiliates, and other companies.

Why can’t I limit all sharing?

Federal law gives you the right to limit only

  • sharing for affiliates' everyday business purposes — information about your creditworthiness
  • affiliates from using your information to market to you
  • sharing for nonaffiliates to market to you

State laws and individual companies may give you additional rights to limit sharing. See below for more on your rights under state law.

Definitions

Affiliates

Companies related by common ownership or control. They can be financial and nonfinancial companies.

  • Our affiliates include companies under common control of Paxful Holdings, Inc.

Nonaffiliates

Companies not related by common ownership or control. They can be financial and nonfinancial companies.

  • Nonaffiliates with which we share personal information include service providers that perform services or functions on our behalf.

Joint marketing

A formal agreement between nonaffiliated financial companies that together market financial products or services to you.

  • Our joint marketing partners include financial companies.

Other important information

We may transfer personal information to other countries, for example, for customer service or to process transactions.

California: If your Paxful account has a California mailing address, we will not share personal information we collect about you except to the extent permitted under California law.

Vermont: If your Paxful account has a Vermont address, we will not share personal information we collect about you with nonaffiliates unless the law allows or you provide authorization.